Amaka Why!

I don call khalid and Wiz Khalifa Make dem com sing for you like say na carnival Oyaa carry your ogbonge body dance to the tune as them dey fill the air with croon . I follow adekunle gold burn the bridge Carry our love go put for inside life fridge I sell my time to buy you orisisiri smile He sweet my body as we dey walk down the aisle. Amaka why! Why!! Why!!! why you con throwey my love like kite Amaka why! Why!! why!!! why you con make me hug pillow every night Amaka Why?? Why you con play my heart like ball why you con make me crumble and fall. Amaka shey you don forget the time wey we dey argue on top curry and thyme Amaka Shey you don forget the night Wey we no sleep dey do pillow fight. Amaka why you con off the light why you con leave my timid heart in fright Weytin go do the future wey we draw on our wall? Shey like wilted leaves,shey dem go fall? abi like broken gourds dem go crumble ? Chaaii our totori lo...