Amaka Why!


I don call khalid and Wiz Khalifa
Make dem com sing for you like say na carnival 
Oyaa carry your ogbonge body dance to the tune 
as them dey fill the air with croon .

I follow adekunle gold burn the bridge 
Carry our love go put for inside life fridge 
I sell my time to buy you orisisiri smile
He sweet my body as we dey walk down the aisle.

Amaka why! Why!! Why!!! 
why you con throwey my love like kite
Amaka why! Why!! why!!! 
why you con make me hug pillow every night 

Amaka Why??
Why you con play my heart like ball
why you con make me crumble and fall. 

Amaka shey you don forget the time
wey we dey argue on top curry and thyme 
Amaka Shey you don forget the night
Wey we no sleep dey do pillow fight.

Amaka why you con off the light 
why you con leave my timid heart in fright
Weytin go do the future wey we draw on our wall?
Shey like wilted leaves,shey dem go fall?
abi like broken gourds dem go crumble ?
Chaaii our totori love wey I dey take fumble.

Amaka why? Why?? Why??? 
Why you con leave me without saying goodbye.

©Iamteazhy

Comments

Popular posts from this blog

The man in my mirror

EVER FAITHFUL GOD

JOURNEY OF A THOUSAND MILES